LiveMonday, September 7, 2026 · Latest press releases across the network
Business

Amazon cargo plane crash in Miami: Five pipo kpai as Amazon cargo plane crash for Miami airport

Wetin we call dis Video, Video show damaged Amazon cargo plane afta crash Author, Max Matza Published 17 minutes wey don pass Read am in 5 mins Five pipo don kpai and five odas dey seriously injured afta one Amazon Air cargo plane overshoot di runway as e try…

Amazon cargo plane crash in Miami: Five pipo kpai as Amazon cargo plane crash for Miami airport

Wetin we call dis Video, Video show damaged Amazon cargo plane afta crash Author, Max Matza Published 17 minutes wey don pass Read am in 5 mins Five pipo don kpai and five odas dey seriously injured afta one Amazon Air cargo plane overshoot di runway as e try to land for Miami International Airport. Di Boeing 767-300 cargo aircraft crash just bifor 14:00 local time (19:00 GMT) afta e depart from Luis Muñoz Marín International Airport for San Juan, Puerto Rico. Di flight also hit several vehicles wey dey ground.

Amazon say dem dey "work closely wit local authorities and officials to understand exactly wetin happun". Di Federal Aviation Administration (FAA) order say make all planes no move as fire crews run to di smoking crash site. Di crash dey come ova Labor Day weekend, one of di busiest travel times of di year.

"At least five pipo don lose dia lives, and five odas dey injured," Miami-Dade County Mayor Daniella Levine Cava tok for one news conference on Sunday evening. She add say rescue crews bin arrive for di scene within "seconds" of di crash. "Right now, our focus dey on di families, dose wey dey injured, and di ongoing response," she continue.

Three of di five pipo wey wound dey for critical condition, Miami Fire Chief Raied Jadallah tok. Di mayor say dem take all of dem to di hospital wit "unknown injuries". Several of di pipo wey wound bin trap inside or under vehicles wey dey ground, and fire and rescue crews gatz comot dem, Jadallah tok.

Officials say e dey too early to know di cause of di crash, and say e go dey investigated by di National Transportation Safety Board. Di federal agency, wey dey investigate all air crashes for di US, plan to hold news conference on Monday. Di Amazon flight operated by 21 Air, wey be charter company based in North Carolina, "overrun Miami International Airport diagonal runway and e dey disabled at di northwest end of di airport," di airport tok for statement.

Miami Dade Fire Rescue say crews "bin arrive to find one airplane wey don catch fire sake of dis crash, wit heavy flames and smoke showing". Wia dis foto come from, Getty Images Over 200 firefighters bin respond to di crash. Dem off di flames, but fuel leak still dey di site, Jadallah tok.

Amazon bin issue one statement wia dem tok say dem dey work closely wit authorities and dem offer condolences to di victims. "We dey heartbroken to learn say five pipo lose dia lives for today incident for Miami International Airport," Kelly Nantel, Amazon Director of Corporate Global Media Relations tok. "Our deepest sympathies go out to di families, loved ones, and all dose wey dey affected by dis devastating loss.

"Di airplane, wey bin dey operated by 21 Air, bin dey attempt to land wen dis incident occur. We dey work closely wit local authorities and officials to learn more and go cooperate fully wit any investigation." Di BBC don email 21 Air about di incident, but has neva receive response. Flight data from tracking site FlightRadar24 show say di Amazon cargo flight bin dey travel at 112 knots (129mph, 207km/h) as e comot for di "useable runway".

For inside one blog post, di site say di plane come to rest near one parking lot wey dey service one Amazon warehouse and oda businesses. E get light thunderstorms and gusting winds for Miami wen di incident happun, di site tok. Di crash dey come during one of di busiest travel weekend of di year for di US.

Passengers for Miami International Airport tell di BBC say dem bin dey frustrated by di lack of information wey dey come from officials, as many flights dey cancelled or delayed sake of di incident. Long lines bin dey for airline counters as pipo try to reschedule travel plans, and some say de go dey forced to stay for Miami for one extra night. Di Transportation Safety Administration (TSA) say 17 million travellers go pass through US airports for di week wey dey lead up to Monday Labor Day holiday.

Di TSA, wey dey screen passengers wey dey fly for di US, predict say 2.3 million pipo go fly on Sunday alone. Wetin we call dis Video, 'Incredibly difficult day' Miami-Dade mayor tok afta pipo kpai Miami International Airport (MIA) dey located near downtown Miami, and na one of di busiest airports for di kontri. "MIA wey dem found for found for 1928 na America busiest airport for international freight and second busiest for international passengers.

E dey offer more flights to Latin America and di Caribbean dan any oda US airport," according to dia website. About 60% of all international visitors to Florida dey arrive for dis airport, MIA tok.

Source: BBC

Distributed to World Stock Push by RedPress.

Related News

Contact Advertise Search RSS